On Top D Tori podcast, na podcast wey go dey yarn orisirisi matter wey dey happen for we society. Na on top this podcast wey be say, we go dey chook mouth for the ogbonge issue and matter for we society...
Make una dey join me every Sunday by 5:30pm. Incase una get question for me or una wan follow chook mouth for the Tori, una fit send me message for my E-mail wey be, Adamaramma0@gmail.com
Make una also dey follow me for my Instagram page @ontop.d.tori
Age ontop Relationship (Older men abi older women?)
Na ontop this Tori we dey yarn whether Age matter for relationship abi e no matter. For contributions and comments make una follow me for my IG: @ontop.d.toripodcast or my email wey be: adamaramma0@gmail.com
25 Jun 2022
Gambling pandemic (Set awon jackpot geng!)
On top this Tori, we go dey shine Torchlight on the issue of gambling, people wey dey Gamble and how e don affect dem. Abeg make una follow me on IG @ontop.d.toripodcast Email: adamaramma0@gmail.com incase if una wan chook mouth, comment or contribute on top this Tori🙂
5 Jun 2022
2023 Election (The need for PVC!)
This episode na to cajole people wey dey reluctant about this election, make Dem get their permanent voters card and vote for the right next president of Nigeria so that we go get a better Nigeria!!!. 💪💪💪
22 May 2022
ASUU STRIKE (more harm than good??🤔)
For on top this Tori we yarn about whether this ASUU STRIKE don affect Nigerian students negatively or positively. For contributions and comments, Abeg make una follow my IG page: @ontop.d.toripodcast or email me: @adamaramma0@gmail.com
15 Apr 2022
Domestic violence! (Endure abi pack your baggages??😄🤷)
This Tori na about wetin women suppose do if Dem dey abusive marriages or if their hubby dey hit dem like say Dem be punching back!😩... follow me on IG: @ontop.d.tori ....email: adamaramma0@gmail.com
10 Apr 2022
Cross dressing (A trend for disguise)
This episode dey yarn about cross dressing for naija and whether cross dressing don do more harm than good for we society🤔🤔
27 Mar 2022
Men and their feelings😔😔
U be lady and your boyfriend or your husband no dey open up to u???🤷...no worry, na on top this Tori u go know the Koko reason why men dey like that😊
13 Feb 2022
Yahoo Yahoo!
This episode dey yarn about whether parents suppose encourage Yahoo or not based on Nigerian economy. 🤔
16 Jan 2022
Inside Bus wahala😅
This episode dey yarn about the orisirisi wahala wey dey shele for inside public transport
12 Dec 2021
Boarding school na still the best option???🤷🤷🤷
On top this Tori, " Boarding school na still d best option"? Dey yarn about if e still make sense make parents dey carry their pikin drop for boarding school base on the orisirisi things wey dey shele on top boarding schools..
28 Nov 2021
Why educated couple's marriage no dey last?🤔🤔
Na on top this Tory we take yarn the reason why be say couple wey go school, their marriage no dey last but na couple wey no go school marriage dey last.
21 Nov 2021
Shey school na scam??🤷🤷
Na On Top this Tori we be say we go take know if school na scam or not.😁
14 Nov 2021
On Top D Tori Trailer
Una dey look for where una go dey get tori? Abi Tory wey go dey Totoro una for body? 😄 On Top D Tori na d korrect place. Make una dey join me every Sunday by 5:30pm😊
Host of On Top D Tori?
Claim your podcast to manage its listing and keep your show details accurate.
Pod Engine is an independent podcast discovery and analytics service and is not affiliated with or endorsed by this podcast. Artwork and show content belong to their owners. Full legal notice.