Una welcome to GEEROH'S Box😘
The confirm podcast wey u need💃
We dey here to dey give una all the ogbonge infomate wey u need to learn about life, love, health, relationship, marriage and even business.
So dey listen to us on Saturdays bcos na steady infomate na we dey carry come on how to better ur life better.
U fit even follow me on Instagram@geeroh_b
Or drop whatsApp message on 07063622626 in case u get any question, opinion or even suggestions.
GEEROH'S Box
With the way things dey go for we country almost everybody dey do their personal business, but no be all the business kan dey grow as we expect.shey u know why? na because most people dey always attach themselves too much with the business,them dey chop pass wetin dem dey put for the business. Oya listen to this episode to hear how u fit make ur business grow.
6 Mar 2021
Shooting your shoot as a woman🤔sey e dey okay?
As a woman shooting your shoot no mean say you cheap, or say you no get level instead e show say you be woman wey sabi wetin she want&they go for am but e get some kain situations wey you no nid shoot am. This episode go explain am give you
27 Feb 2021
How To Build The life Wey You Love
Most of us today find ourselves for where we no expect because of the way the country be, some don even forget their dreams and the ones wey still dey chase their dreams na through their Plan B. So Ask yourself shey I get PLAN B?
19 Feb 2021
MARRIAGE: Finding MR or MRS
Instead make you find soulmate find your missing part, person wey go complete and compliment you.Remember say wetin you no fit collect for marriage no pretend or collect am wen una dey date. This episode go gist abt wetin you nid check wen you dey find partner.
6 Feb 2021
RELATIONSHIP: Shey Cheating Good For Relationship?
Some people (Single) talk say cheating dey help dem fit know &choose which partner dey okay for dem to settle with, and odas say(married) e dey help dem ease marital stress. Wetin be your own answer shey na Yes e good abi na No. Listen to this episode to hear the confirm answer.
30 Jan 2021
LIFE: Your Money💰Or Your Life
Money sweet, e good,e dey important,na d only tin wey fit carry you go anywhere for this world but e no fit bring u back or replace u wey be the driver. So think am wella bcos e get somethings wey u dey do wey show say u prefer money dan ur life. This episode go gist u about those tins.
23 Jan 2021
LIFE: Why me🤔(wetin to do)
Dis na question wey every1 don reason either na say no work, health mata,failed marriage,wen person wey u love die& many more. But d tin na say u no nid worry too much again bcos ur own beans go soon durn.
16 Jan 2021
LOVE: Special Announcement 4Men
To b man no easy bcos u get plenty things wey u dey tink of n sometimes u fit forget the little things wey b koko.This tori talk abt 13 things wey u as man no nid eva try wit ur woman bcos body fit dey pepper her 4 sum tins bt she no go just tell u.
14 Jan 2021
LIFE:Talent wey u nid get as woman
Shey u knw say as woman e get sum kan talent wey u nid showcase wey go make u b better wife,sister,mother or even oga for work. Yes we gree say nobody wan old so e even get some kan tins wey u nid do to kip u healthy and young.
2 Jan 2021
LIFE : 2021 na new fight plan now
We know say 2020 na one Kan tough year wey shake everybody starting from the coro matter to lockdown n from deir enta end sars protest,even people loose life,job,property and things Kan ova deir. But the good thing na say e give us break time to pause , think our life and see how we need tighten our seat belt. This podcast go tell us wetin we fit do make 2020 no repeat e self for 2021.
2 Jan 2021
GEEROH'S Box (Trailer)
Reach and audience
Public platform figures. Ratings count people who left a rating, not total listeners.
Apple Podcasts (US)
5.0 / 5
1 ratings
Contact GEEROH'S Box
Guest appearances
Does not typically book guests
Based on episode analysis; this does not confirm that the show is currently accepting guests.
Host of GEEROH'S Box?
Claim your podcast to manage its listing and keep your show details accurate.
Pod Engine is an independent podcast discovery and analytics service and is not affiliated with or endorsed by this podcast. Artwork and show content belong to their owners. Full legal notice.
Explore this show Podcast research with Pod Engine